Wia dis foto come from, Getty/Hon. Tomaïno Ndam Njoya Facebook/Joshua Osih/X

Cameroon Electoral Commission (ELECAM) don exclude Cameroon opposition leader Maurice Kamto from di list of candidates wey go contest for di October 12 presidential election.

According to di list wey di kontri electoral body release on Saturday, 26 July, dem only approve 13 out of di 83 candidates wey declare dia intention to run.

E neva dey clear why dem remove Kamto from di list, but di decision bin come afta e announce say im dey comot di Cameroon Renaissance Movement (CRM) party to join anoda party wey endorse am as candidate.

Bicos di CRM party no fit endorse candidate sake of say dem no get any elected representatives for parliament or local councils, e decide to join MANIDEM party, wey get local representation.

Who dey di list?

Some of di candidates Elecam approve

Wia dis foto come from, Cameroon presidential

92-year-old Cameroon President Paul Biya dey part of di candidates wey make di list.

Im former allies, Issa Tchiroma Bakary and Bello Bouba Maigari wey come from di vote-rich northern parts of di kontri also make di list.

Popular anti-corruption lawyer Akere Muna, Social Democratic Front (SDF) party leader Joshua Osih, lawmaker Cabral Libii also dey among di candidates wey go contest for di kontri top job.

Meanwhile, di firebrand mayor Patricia Tomaino Ndam Njoya na di only female candidate on di list.

Foto of Cabral Libii

Wia dis foto come from, CABRAL LIBII/Facebook

Cabral Libii – Presidential candidate Cameroon Party for National Reconciliation

Cabral Libii Li Ngué, wey dey known as Cabral Libii, na Cameroonian journalist, law lecturer and Member of Parliament dem elect for February 2020.

Dem born am on March 29, 1980 for Ekoamaen (Central Region, Cameroon)

E dey run for di October presidential election under di platform of di Cameroon Party for National Reconciliation (PCRN).

Oga Libii bin consistently reject di Cameroonian Electoral Code, wey allow Paul Biya to run again for president.

For 2017, e declare im candidacy to run for di 2018 Cameroonian presidential election. Dat na di first time e go run, and e be 38-year-old at di time, wey make di youngest candidate, wey Univers Party endorse.

E launch one bold campaign called “11 Million Registered Voters.”

As dem announce di election result, e officially receive 6.28% of di votes wey put am for di 3rd position,

But few months afta di presidential election, kasala burst between di am and di president of “Univers” party. Di president bin ask am to account for how e take manage di money for di presidential election.

Oga Libii later join di Cameroon Party for National Reconciliation (PCRN) and dem appoint am as head of di party for 2019. Dem later elect am as Member of Parliament during di municipal and legislative elections on February 9, 2020, plus four oda party members.

Foto of Osih Joshua

Wia dis foto come from, Osih Joshua/Facebook

Osih Joshua – Presidential candidate for Social Democratic Front (SDF)

Oga Joshua na Cameroonian businessman. Dem born am on on 9 December 1968 for South West region of Cameroon.

Osih join di Social Democratic Front (SDF) for March 1991 for Douala.

For 2002, dem elect am as di regional chairman of di Social Democratic Front for di South West region.

For 2006, dem elect am as di 2nd Vice Chairman of di party.

For 2012 and 2018, dem vote am as di 1st Vice Chairman of di party. During di 2018 Extra-ordinary convention of di party, di party select am as di presidential candidate for SDF.

Osih get MBA in Leadership and Sustainability, and e get more dan 25 years of experience in di aviation industry.

Osih na popular entrepreneur for Cameroon and di founder and managing directors of Camport PLC and Africa Travel Management.

Osih na member of di Cameroon Parliament for di Wouri Centre constituency in Douala.

E don serve as both Vice President of di Finance and Budget Committee of di National Assembly, and Special Rapporteur for di National Assembly.

Foto of Akere Muna

Wia dis foto come from, Akere Muna/Facebook

Akere Tabeng Muna – Presidential candidate for Univers party

Akere Muna na di founder and former President of Transparency International (TI) Cameroon. E be lawyer by training.

For 2007-2008, dem appoint am as member of di independent High-Level Audit Panel of di African Union.

E be one former President of di Pan African Lawyers Union (2005-2014) and former President of di Cameroon Bar Association.

For January 2010, e dey elected to di Panel of Eminent Persons, wey dey oversee di African Peer Review Mechanism (APRM). E later become di Chairperson of di panel until di end of im tenure for 2014.

Akere Muna na member of di Governing Board of di Africa Governance Institute and serves, since 2013, as member of one High-Level Panel on Illicit Financial Flows from Africa, wey former South African President Thabo Mbeki dey lead.

E run for President for 2018 elections for Cameroon. E later form one coalition wit anoda candidate and e withdraw im candidacy in favor of di latter.

E continue im work on di AU High-Level Panel on Illicit Financial Flows from Africa, plus im work on anti-corruption and good governance across di globe.

Foto of Paul Barthélemy Biya'a bi Mvondo for di Space Forum for di U.S. - Africa Leaders Summit on December 13, 2022 in Washington.

Wia dis foto come from, Getty Images/ Kevin Dietsch

Paul Biya – Presidential candidate for Cameroon People’s Democratic Movement (RDPC)

Paul Biya na di current president of Cameroon. Dem born am on 13 February 1933 for di village of Mvomeka’a, South region of Cameron.

Di 92-year-old don dey power for di past 43 years, since 6 November, 1982.

E graduate from Institut des hautes études d’Outre-Mer in 1961 wit Diploma degree in Public Law.

E serve under di goment of di former President Ahmadou Ahidjo.

In 1965, e serve as di Director of Cabinet of di Minister of National Education, Youth Affairs and Culture in January 1964 and later Director of di Civil Cabinet to di President in December 1967

E also serve as director of di Civil Cabinet and Secretary-General of to di Presidency of di Republic in January 1968.

Following di creation of unitary state in 1972, e become Prime Minister of Cameroon on 30 June 1975.

Afta, Ahidjo resign as president Biya on 4 November, 1982. E take ova power on 6 November, 1982 and e neva comot from power since den.

Ahead of di polls, critics don argue say plan bin dey to exclude Maurice Kamto wey come second for di 2018 presidential polls make e no challenge Oga Biya for dis year election.

Oga Biya wey pipo reason say na di favourite to win for di October election bin reject calls to step down, as e say im still get a lot to offer Cameroonians, even though e don dey for power for nearly 43 years.

Aspirants wey dey para sake of say dem dey disqualified from di presidential race get two days to file petition for di constitutional council within two days.

Share.
2025 © Network Today. All Rights Reserved.